8 Jehoiashin na eighteen year wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama na Nehushta and na Elnatan wey kom from Jerusalem, born am.
God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.