Di remainin tins wey Jehoiakim do wen e dey rule, all di big-big sins and bad tins wey e do, dem rite dem for Israel and Judah kings history book. En pikin Jehoiashin kon take-ova as king.
God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.