2 Kings 24:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
20 So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.
Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’
Wen Jehoiakim dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack dem. Jehoiakim obey King Nebukadnezzar for three years, den e kon won fight against am.
King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God.
Den fire katch di vine kon burn evritin plus en fruit finish and e nor go ever strong again. E nor go ever bi dat royal rod again. “Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?