2 Kings 24:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey kom form Libnah, born am.
Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin.
King Zedekaya send Pashhur wey Malkijah born and Zefanaya, di priest wey bi Maaseaya pikin, go meet Jeremaya, but God don tell Jeremaya before dem rish der. Zedekaya sey make dem tell Jeremaya sey,
Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,