King Nebukadnezzar karry evribody komot from Jerusalem, plus di ofisas and sojas (all di pipol, na 10,000). Plus all di men wey get skill and doz wey dey work with iron. E nor leave anybody esept di poor pipol wey dey di land.
I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.
E choose one of Jerusalem king broda, enter agriment with am kon make am swear sey e go always dey loyal to am. E katch and karry important pipol go prison,
tell dem sey di Oga God wey get pawa well-well sey: “One big eagle wey get fine and long feadas, fly go Mount Lebanon kon break di branches wey high pass for one cedar tree komot,