Fero kon koll Josef, Zafenat-Paneah. E still gi-am Asenat wey bi Potifara dota, priest for On, so dat di woman go bi Josef wife. So Josef kon dey kontrol di whole Egypt.
Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.
God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.