2 Kings 23:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English3 Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
E si di king stand near di pila for where dem take dey enter di temple. Di ofisas and doz wey dey blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land happy dey blow dia trumpet. Doz wey dey sing, dey der with difren instrument as dem dey lead di song. Atalaya tear en klot kon dey shaut, “Dis na wayo! Dis na wayo!”
I pul di garment wey I wear kon shake am. Den I sey, “Na so God go take shake any of una wey nor keep en promise. E go distroy una house and evritin wey una get and nor-tin go remain for una.” Evribody wey dey der kon sey, “Amen!” Den dem kon praiz God. And di ofisas and doz wey get money, do wetin dem promise.