“Make una go meet and ask God for mi and Judah pipol. Make una find out wetin di words for di book mean. God don dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor gri obey wetin dey dis book at-all.”
So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.
Afta King Josaya don do all dis tins for di temple, King Neko for Egypt kon go fight with Karkemish for Eufrates River and Josaya kon go try to stop am.
Make awa leaders handle di matter. Den make doz wey marry woman from anoda kountry, kom gada with di leaders and judge dem for di town for di time wey dem gri sey make wi meet, until God nor go dey vex for us again.”