If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
If dem really turn from sin kon pray to Yu for dat land as dem face dis town wey Yu give awa grand-grand papa dem (dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu),
Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.
If yu take cedar wood build house and e fine pass oda pipol own, na dat one make yu bi betta king? Yor papa enjoy life well-well, bikos e always dey good and kind, so e prosper for evritin wey e do.