Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 23:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 All di priests for di high place, e sakrifice dem for di altars wey dey der kon burn human being bones for der. Den e go back to Jerusalem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 23:20
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.”


Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.


Wen e don offa di sakrifice finish, Jehu kon tell di guards for di palis, “Make una enter inside di temple go kill all of dem and make no one eskape!” Di guards and ofisas kill all of dem for der kon trow dia body for outside, den dem waka enter inside di main room for di juju temple.


Di pipol kon go skata dia juju, di juju house dem and en altar. Dem kill Mattan wey bi di juju priest for di altar front. Jehoiada kon put guards for di Temple.


E burn di juju priest bones for di altars where dem for dey woship before. Bikos of all dis tins wey e do, Judah and Jerusalem kon dey holy again.


“Anybody wey follow animal sleep, dem must kill-am.


“Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.


Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.


I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.


But for di profet and doz wey dey si wetin go happen, make una kill dem, bikos dem won make pipol sin against di Oga una God wey take una komot from Egypt where una for bi slave. Una must kill dem, bikos dem dey try to deceive una komot from di way wey God wont make una follow. So like dis, una must skata and distroy evry bad tin or pipol wey dey among una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ