Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 23:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 E skata dia juju pila finish kon kut Asherah juju pole rish groun, den e pak human being bones full di shrine.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 23:14
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”


As King Josaya turn, e kon si di grave for di mountin, so e sey make dem bring di bones kom out. E burn dem for di altar kon skata di ashes. Dis tin happen, just as God tok thru en profet for di time wey King Jeroboam stand for di altar, wen dem dey do one feast. King Josaya turn kon si di grave of di profet wey tok dis tins.


Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.


But una must distroy dia altars; skata dia images and kut dia Asherah juju poles trowey.


So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.


Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’


I go skata Israel pipol dead body for evriwhere; I go skata dia bones round di altar.


I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”


Anybody wey tosh pesin wey dem kill with swod for war or anybody wey tosh dead body, human being bone or grave, go dey unklean for seven days.


Den e go bring hyssop leaf, deep am for wota kon sprinkol am for di tent, evritin for inside; for di pipol wey dey der and for di pesin wey tosh dead body, pesin bone or grave.


una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.


Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ