From di first day wey di festival start go rish di end, dem dey read one-one part from God law evriday. Dem celebrate for seven days kon finish di festival for di eight day, just as dem rite am for di law.
Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.
Den di king tell Jehudi, “Make yu bring di book kom.” So, Jehudi go bring di book kom from Elishama room kon read am give di king and en ofisas wey stand round am.