So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.
May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”
As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.
God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”
E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.
God tell mi, “Jeremaya, if anybody among my pipol, or profet or priest ask yu, ‘Wetin God tok?’ Make yu tell dem sey, ‘Una dey disturb God and E go distroy una.’
Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.
Jerusalem enemies don turn dia oga naw and dem dey prosper, bikos God ponish Jerusalem pipol for di sins wey dem kommit. Dem don katch and take dia shidren go far land.
I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’