2 Kings 20:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
20 Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book.
Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot.
King Hezekaya block where wota from dey kom on-top Gihon kon direct am go di west side for David Town. So, God kon bless King Hezekaya for evritin wey e do.
Di remainin good tins wey Hezekaya do, dem rite dem for di book wey bi Profet Isaya wey Amos born, own. Dem still rite dem for Judah and Israel kings history book.