Isaya ansa, “Dis na di sign from God to show sey E go do wetin E tok. Yu go wont make di shadow for wall move go front ten times, abi make e go back ten times?”
God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”
Di sun and di moon stand for one place as Israel pipol kill all dia enemies. Dem rite dis tins wey happen for Jasha Book (wey mean Raitious Book). Di sun nor move for di sky centre and e shine for one full day.