And na true sey, my oga know wetin I do wen Jezebel dey kill God profets. I hide hundred profets for two kave, fifty-fifty for each kave and I dey give dem wota and food.
Den dem tell Elisha, “Fifty strong men dey here with us wey bi yor savants, abeg make yu let dem go find yor oga. May bi God Spirit don karry am go put for one mountin or valley.” But Elisha sey, “No! Make una nor send dem go.”
One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
Gehazi ansa, “Yes! Evritin dey okay. Na my oga send mi kom meet yu sey, ‘Two of di profets savant just kom meet mi from Efraim hill kountry. So make yu give dem silva wey heavy rish seventy-five pounds and two difren klot.’ ”
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.