4 Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jeriko.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go Jeriko togeda.
For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.
Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait for mi, bikos God send mi go Bethel.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go Bethel togeda.
For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”
But Rut ansa, “Nor force mi sey make I leave yu! Anywhere wey yu go, na der I go-go. Anywhere wey yu won stay, na der I go stay. Yor pipol go bi my pipol and yor God go bi my God.