Den di king send one offisa with fifty sojas make dem go arrest Elijah kom. Dem go meet Elijah for where e sidan on-top hill kon tell am, “Profet! Di king sey make yu follow us kom!”
But King Jehoshafat ask, “Wi nor get any profet among us for here? Make e help us find out from God.” One of Israel king savant kon ansa, “Shafat pikin, Elisha wey bin dey pour wota for Elijah hand, dey here.”
So di woman drive go meet Profet Elisha for Mount Karmel. Wen Elisha si di woman from far, e kon tell en savant Gehazi, “Si, na dat Shunem woman dey kom so.