Elisha waka go where di wota for dey flow, pour salt put kon sey: “Dis na wetin God tok: ‘I don make dis wota good. E nor go ever kause deat or pain again.’ ”
From Jeriko, Elisha kon go Bethel. As e dey waka for di street, some small-small boys kom outside from di town kon dey curse am dey sey, “Bololo head! Bololo head!”