Elijah komot from der kon si Elisha, wey Shafat born, dey work with twelf melu for en farm. E sidan on-top one, while eleven dey en front. Elijah remove en own klot kon use am take kover Elisha body.
As Elisha dey look, e kon dey shaut, “My papa, my papa, di shariot and sojas for Israel!” So e nor ever si Elijah again. Elisha kon tear en own klot to pieces.
Den e take di garment wey Elijah drop for am take nak di wota kon sey, “Where di Oga wey bi Elijah God?” Den e nak di wota again and di wota divide into two. So Elisha kon waka pass go di oda side.
Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow.
Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun.