Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.
“Three years wey food nor go too dey; or three monts wey una go dey run from una enemy sojas; or three days wey God go attack una with sickness and en angel go bring deat kom dis land? Na wish one yu wont make I tell God?”
Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.
Bikos Oga God go waka pass Egypt kon kill pipol, but wen E si di blood for di up and two side for una door, E go waka pass and E nor go enter una house kon kill una.
But awa Oga God wey get pawa go kut and skata dem for groun like tree branches. Di ones wey dey proud and dey karry body up, God go ponish dem well-well.
But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”