Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 19:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Dem nor tell yu sey na mi plan all dis tins before dem happen? I don do as I plan dem. Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well, to where dem dey trowey dirty put.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 19:25
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.


True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.


But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”


Na mi kreate both lite and darkness; di Pesin wey dey bring blessing and wahala and na mi wey bi God, dey do all dis tins.


I go send viktory kom from di sky like rain, so make di eart open and receive am; so dat salvashon and korrect judgement, go grow. Mi, wey bi God, go make dis tins happen.”


Na mi kreate di man wey dey melt gold, make fire and form weapon and na mi still kreate di soja wey dey use di weapon kill pipol.


“So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ