Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 19:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Naw, my Oga God, make Yu save us with yor pawa, so dat all di kingdoms for dis eart go know sey na Yu bi Oga and di only God wey nor dey die.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 19:19
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipol tok sey I bi god for mountin and nor bi for groun, I go make yu win dia many sojas and yu and yor pipol go know sey na mi bi God.’ ”


dem go kon woship and pray to Yu for dis temple.


My Oga God, make Yu listin to dia prayer. For heaven wey Yu dey, make Yu hear and do wetin dem sey make Yu do, so dat evribody for di world go know and obey Yu, just as yor pipol Israel dey do. Den dem go know sey dis temple wey I build, na di place where dem go for dey woship Yu.


so dat all di nashons go know sey na only God bi God and e nor get anoda god.


Hezekaya pray to God kon sey: “Oga wey bi Israel God, na Yu bi king among di creatures wey get feadas! Na only Yu bi God ova all di kingdoms for dis eart. Na Yu make di sky and di eart.


Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”


“Make una tank and koll God name! Make una let di whole world know di tins wey E do!


Afta King Hezekaya do all dis good tins for God, King Sennakerib for Assyria with en sojas kon go attack Judah.


Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.


God sey, ‘Naw, wetin I go do, go make yu know sey na mi bi Oga God.’ Si, I go nak di wota for River Nile with di stik wey dey my hand and e go shange to blood.


E do am make all di kountry for eart know sey na God get all di pawa, so una must always obey di Oga wey bi una God.”


Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ