18 Dem don burn di gods for di oda kountries, bikos dem nor really bi god, bikos na human being make dem with dia hand from wood and stone. Dat na why Assyria king fit distroy dem.
Wen Filistia pipol dey run, dem run leave dia juju and David and en men kon karry dem komot.
Dem bring di pila for di juju temple kom outside kon burn dem.
“My God, na true sey, Assyria king don distroy all di kountries and dia lands.
Even kingdoms wey dia juju strong and fine pass Jerusalem and Samaria own, I still distroy dem.
Pipol fit make dia own gods? No! Wetin dem make, nor bi god at-all.”
So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make.