Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
Among all di gods for di land, na wish one don fit save en pipol and land from my pawa? So how God won kon take save Jerusalem and en pipol from my hand?”
E rite leta kon curse di Oga wey bi Israel pipol God sey: “Di gods for all di nashons nor fit save dia pipol from my pawa. Even King Hezekaya God nor go fit save en pipol from my pawa.”