Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well.
Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop.
E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
For dis time, Filistia pipol don still go fight Judah towns for di low lands and Negev Valley. Dem take-ova Bet-Shemesh, Aijalon, Gederot and Soko, Timnah, Gimzo and all di towns wey near dem kon stay der.
Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
E build fence round di land kon remove di small-small stones wey nor go make di vine grow well, den e plant vine put. E build one towa for di middle kon dig pit where e go press di grape put. But as e dey wait, instead make di grape produce betta fruit, e kon produce bad ones.