King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.”
King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya.
E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.
King Hezekaya block where wota from dey kom on-top Gihon kon direct am go di west side for David Town. So, God kon bless King Hezekaya for evritin wey e do.
God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.
Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.