Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 18:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 18:6
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”


Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.


Leta, Judah pipol nor gri obey wetin di Oga dia God tok; dem kon dey do like Israel pipol.


“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.


“Oga God, make Yu remember sey I dey faithful and loyal as I dey serve Yu. I always dey do wetin Yu wont make I do.” Den e kon bigin kry well-well.


Wen I take Israel, my pipol komot from Egypt where di land bi like fire for dia body, na der I for make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipol and I go bi dia God.


“If una love mi, una go do wetin I tok.


Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”


If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.


Una go bi my friend if una do wetin I tok.


Wen e rish der kon si how God don bless di pipol, e happy well-well kon enkourage dem sey make dem kontinue to woship God with all dia heart.


Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.


Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.


But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.


To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ