King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.”
Di Assyria ofisas still sey, “May bi una go tell mi sey, ‘Wi trust di Oga awa God.’ But nor bi en Hezekaya curse? Hezekaya nor skata all en shrine and altars kon sey evribody for Judah and Jerusalem go woship for only one altar for Zion?