Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 18:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’ “So make una nor listin to Hezekaya, bikos e dey deceive una wen e sey, ‘God go save us.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 18:32
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E tie en donkey put for di vine, di vine wey e choose. Na wine e take dey wosh en klot and na grape e take dey wosh en garment.


So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town.


“Make una tell King Hezekaya for Judah sey: ‘Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.”


Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.


But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


till di king go put una for one kountry wey bi like una own; where vineyard dey wey go give una wine and flower to take make bread.


If God dey happy with us, E go take us go der kon give us dat land wey full with milk and honey.


di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ