Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.
For di fourt year wen King Hezekaya dey rule (dat na seven years wey Elah pikin, King Hoshea don dey rule for Israel), King Shalmanesa for Assyria go fight Samaria kon surround di town.
I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”