And for evry fifteent day for di eight mont; di day wey en ensef choose; e dey go di altar for Bethel go do sakrifice to celebrate di feast, wey e dey do for Israel pipol.
Afta dem beri am, di profet tell en shidren, “Wen I die, make una beri mi for dis grave where I beri dis profet put, den make una put my bones near en own.
King Jeroboam for Israel nor still shange from di bad tins wey e dey do, but e kontinue to dey choose priest from ordinary family make dem kon serve for di altar wey e build. Na pipol wey just like to bi priest, e dey make priest.
King Josaya still distroy all di shrine for di high place for Samaria town. Na Israel kings build dem and dem dey make God vex. As e take distroy di altar for Bethel, na so too e distroy all dis ones.
dem go meet Zerubabel and di leaders kon tell dem, “Make una allow us join una ribuild di temple. Bikos wi dey woship di same God wey una dey woship and wi dey offa sakrifice to am ever since King Esarhaddon for Assyria send us kon stay here.”