2 Kings 17:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
31 di ones wey kom form Avva, make Nibhaz and Tartak; while doz wey kom form Sefarvaim dey burn dia sons for fire as sakrifice to Adrammelek and Anammelek wey bi Sefarvaim gods.
One day as e dey woship en god for Nisrok temple, en sons, Adrammelek and Shareza kon kill-am with dia swod, den dem run go Ararat land. Sennakerib pikin, Esarhaddon kon take-ova as king.
Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.
Make una make sure sey una obey all di kommand wey I dey give una, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren, bikos una do wetin dey good and betta for una Oga God eye.
Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.