God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”