Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 17:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 17:23
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.”


God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”


I go remove una from Israel pipol and di land wey I give dem. I go still abandon dis temple wey I don make holy sey make dem for dey woship mi. Pipol for evriwhere go laf Israel pipol and dem nor go respet dem again.


But God look Israel pipol kon sorry for dem. God help dem, bikos of di promise wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. Till today, E nor like to distroy or remove dem from en present.


God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”


So, bikos God dey vex for Israel pipol, E kon rijet dem; but Judah tribe still dey obey am.


So God rijet all Jakob shidren-shidren; E disgrace and give dem to tif, until E komot all of dem from en present.


Israel pipol kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin and dem nor gri turn kom meet God.


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,


God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”


Just as God don tok before, E rijet Judah and en pipol, bikos of all di sins wey Manasseh kommit.


King Nebukadnezzar sey make dem kill all of dem for Riblah wey dey near Hamat. Na so dem take karry Judah pipol komot from dia land.


But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.


Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.


Den I go tish wiked pipol yor ways and dem go turn kom meet Yu.


bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.


Bikos God dey vex for Jerusalem and Judah pipol, E kon porshu dem komot for en present go Babilon town. So Zedekaya kon plan against Babilon king


Just as I porshu Israel pipol wey bi una relashon, na so too, I go porshu una komot from my front. Mi, Oga God, don tok.”


Even for dia mama belle, Jakob struggol with en broda Esau and wen Jakob grow, e still struggol with God.


follow body wen I take una as slaves go anoda land wey far pass Damaskus.” Oga God wey dey mighty don tok.


All dis tins go happen bikos of Israel pipol sturbones and sin. Una ask sey, “Na how wi take sturbon? Na who dem go blame for Israel pipol sturbones?” Nor bi Samaria wey bi di main town! “Where di place wey dem for dey serve juju?” Na Jerusalem dem dey!


“So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.


So wen di time rish to divide land for God pipol, dem nor go give una any part.


God sey, “I go rijet dem, I go si wetin go happen to dem; bikos dis generashon dey show sey dem too know and dem nor get sense.


den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.


Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin, dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go Babilon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ