Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.
Wen King Josaya dey rule for Judah, God tell mi sey, “Israel pipol wey nor dey faithful, yu si all wetin dem dey do? Dem don waka leave mi kon dey do ashawo for under evry green tree and high hill.
I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin.