King Ben-Hadad gri with wetin King Asa tok, so e send en sojas go attack Israel towns. Dem win Ijon, Dan, Abel-Maim and all di towns where Naftali pipol dey keep tins put.
Di Oga wey bi en God kon gi-am to Siria king. Siria pipol win and karry Judah pipol go Damaskus as prisonas. God still gi-am to Israel king and e kon distroy en kingdom.
“Di bricks house don fall, but wi go build am with stone again. Dem don kut di sikamore tree, but wi go replace am with cedar wood wey fine well-well.”
God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.