3 E dey do like odas wey rule Israel before am. E even burn en pikin as ofrin and dis na one bad sin wey di kountries wey God porshu komot for der, dey do.
Di one wey bad pass bi sey, e get some wimen wey dey do ashawo work for doz place wey dem for dey serve juju. Judah pipol do tins wey dey make pesin shame, just as di pipol wey God drive komot for di land before, dey do.
Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
“King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.
E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
E rule as di oda kings for Israel, en wife na Ahab pikin and just like Ahab family, en too join for di wiked tins wey Israel king dey do. E sin against God,
E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.
Dem build altar for Baal juju for Ben-Hinnom Valley where dem for dey sakrifice dia shidren give Molek god. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.”
Even till today, dem still dey offa di same sakrifice and dey distroy demsef with di juju, bikos dem dey burn dia shidren for fire gi-am as sakrifice. Den Leta, una go still kom ask sey wetin I wont! But as long as I bi God wey get pawa and di God wey nor dey die, I nor go let una ask mi anytin.
Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.