2 Kings 16:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
17 King Ahaz kut di stand komot kon remove di basin from dem. E take “Di Sea” from di bull wey dem make with bronze and wey dey support am kon put am for groun.
Di roof wey dem build for di temple and for di door-mot where di king dey pass enter inside for Sabat Day, e remove am too. E take dem komot, bikos e wont make Assyria king, happy.
Di two pilas, di Sea with di twelf bronze melu image wey dey under am and di wota pot and wetin dem karry, many well-well. Dem make and put dis tins for God temple wen King Solomon dey rule.