Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 16:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For seventeen years wey Remalaya pikin, Pekah dey rule, Jotam pikin, Ahaz kon bi king for Judah.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 16:1
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jotam die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Ahaz kon take-ova as king.


For twelf years wen King Ahaz dey rule Judah, Elah pikin, Hoshea kon bi king for Israel. E rule from Samaria for nine years.


Ahaz born Hezekaya; na Hezekaya born Manasseh and na Manasseh bi Amnon papa.


Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.


Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.


God send anoda messenja go meet King Ahaz sey.


So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.


Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.


Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ