Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 15:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 God kon make di king sick. Di king get diziz for en skin until di day wey e die. Only en kon dey stay for one house, while en pikin Jotam dey kare, handle di palis and rule di pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 15:5
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”


David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind.


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”


For di sekond year wey Remalaya pikin, King Pekah dey rule Israel, Uzzaya pikin, Jotam kon bi king for Judah.


Di remainin tins wey Zabud do, plus all wetin e get, dem rite am for Judah kings history book.


Bikos of dis tin wey yu do so, Naaman diziz go katch yu and yor shidren-shidren forever.” So wen Gehazi komot from Elisha front, di diziz kon katch am and en body kon dey white like snow.


Four men wey get diziz for body, sidan for di town gate. So dem tell demsef, “Wetin make us just sidan for here dey wait di time wey wi go die?


Joash born Amazaya wey born Zabud; Zabud born Jotam and Jotam kon born Ahaz.


(Dem rite all dis tins wen King Jotam dey rule for Judah and King Jeroboam dey rule for Israel.)


E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.


My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!


Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.


As long as e get dis diziz, e go dey unklean and una go keep am for where pipol nor dey-dey for outside di kamp.


Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.


Wen di kloud komot di tent, leprosy kon full Miriam body like snow. Den Aaron look Miriam, kon si sey leprosy full en body!


God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”


As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ