Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.
bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.
“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.
Bikos na from my own town I go for start to distroy kom rish dia own. Dem tink sey dem nor go ponish dem? No! Dem go ponish dem, bikos I go send war kom meet evribody for di eart. Mi, wey bi God wey dey mighty, don tok.”
Den tell di pipol sey, ‘Mi wey bi Israel God wey dey mighty go bring my savant, King Nebukadnezzar for Babilon kom dis place and e go put en throne kon spread en royal tent on-top dis stone wey Jeremaya beri so.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.