E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
E koll di soja ofisas, di eldas, doz wey dey rule di pipol and all di pipol for di land, den kon lead di king komot from God Temple. Dem use di gate for up take enter di palis and di king kon sidan for en throne.