24 E nor gri obey God kommand; e kontinue to do like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.
E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin. Wen e dey rule,
For fifty years wen King Zabud dey rule for Judah, Menahem pikin, Pekahaya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for two years.
En offisa Pekah wey bi Remalaya pikin plan against am. En and fifty men from Gilead kon kill King Pekahaya, Argob and Arieh for Samaria. Dem kill dem for di place wey dem dey guide pass for di palis. Pekah kon take-ova as king.
E nor gri obey God, just as en grand-grand papa dem do. E kontinue to do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.