Menahem kollect di silva from di rish pipol wey dey Israel. E take fifty-fifty silva from all of dem kon gi-am to Assyria king. Den Assyria king komot dia land and e nor kom back again.
Di time dey kom wen yor pipol go sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin!) and Yu go dey vex for dem kon give dem to dia enemies wey go take dem go as prisonas for anoda land, weda e far or near.