For di twenty-sevent year wey Asa don bi king for Judah, Zimri kon rule Israel pipol from Tirzah for seven days, wen Israel sojas dey take-ova Gibbeton town for Filistia
But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.