Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 15:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Di way wey dem take kill-am kon make wetin God tok happen wen E tell Jehu sey, “Na four generashon for yor shidren go rule Israel.” And dat na wetin happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 15:12
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dis show sey evritin wey God tok about Ahab and en family, must happen. God don do wetin E tok thru en savant, Elijah.”


God kon tell Jehu, “Evritin wey I won make yu do to Ahab family, yu don do am. So I promise yu sey yor shidren-shidren go bi king for Israel from naw go rish di fourt generashon.”


For di twenty three year wen King Joash, Ahazaya pikin dey rule Judah, Jehoahaz wey bi Jehu pikin kon bi king for Israel. E rule from Samaria for seventeen years.


For di thirty-seven year wey King Joash dey rule Judah, Jehoahaz pikin, Jehoash kon bi king for Israel. E rule from Samaria for sixteen years.


Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with di kings for Samaria.


Jeroboam die and en pikin Zekaraya kon take-ova as king. Dem beri am with Israel kings for Samaria.


Di remainin tins wey Zekaraya do, dem rite am for Israel kings history book.


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


Heaven and eart go vanish, but my word go dey forever.”


If dem koll di pipol wey God send en word go meet, sey, ‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange,


So di sojas tell each oda sey, “Make wi nor tear am, but make wi gambol to si who go take am.” Dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem go divide my klot, afta dem don gambol for am.” Dis na wetin di sojas kon do.


“My brodas, di word wey di Holy Spirit use David tok about Judas, wey show road to di pipol wey arrest Jesus Christ, must happen,


Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ