Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 14:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 God si as Israel pipol dey sofa; di sofa strong well-well, bikos nobody dey to help dem, weda slave or free man.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 14:26
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“ ‘ “Bikos of dis, I go skata yor throne kon kill all yor sons and shidren-shidren; both di ones wey don old and di yong ones. I go finish yor family; dem go swip dem komot like dirty.


So God sey, ‘I go put wahala for yor head. I go kill yu and all di men for yor family; both yong and old ones.


But God look Israel pipol kon sorry for dem. God help dem, bikos of di promise wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. Till today, E nor like to distroy or remove dem from en present.


Jehoahaz kon tell God make E forgi-am and God ansa en prayer, bikos E si sey King Hazael really dey sofa Israel pipol.


Evribody for Ahab family go die finish. Evry son wey dey Ahab family for Israel, I go kill all of dem, both di ones wey dey free and di ones wey bi slave.


and na dis rizin make God ponish dem, so dat dem go learn, bikos wen dem fall, nobody dey to help dem.


So, make Yu nor too stay far from mi, bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.


God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.


True-true, Israel pipol kry don rish my ear and I don si how Egypt pipol dey sofa and opress dem.


from all dia sofa. Nor bi angel save dem, but na God save dem by ensef. E use en love and mesi take save dem. E dey kare for dem since,


“I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody.


God go judge en pipol and E go shange en plan about en savant; wen E si sey dia pawa don vanish and nobody remain again, weda na slave or free pesin.


So dem skata all dia yeye gods kon bigin woship God; den God kon sorry for Israel pipol, bikos of dia sofa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ