2 Kings 14:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
23 For di Fifteent year wen Joash pikin, King Amazaya dey rule Judah, Joash pikin, Jeroboam kon bi king for Israel and e rule from Samaria for forty-one years.
God kon tell Jehu, “Evritin wey I won make yu do to Ahab family, yu don do am. So I promise yu sey yor shidren-shidren go bi king for Israel from naw go rish di fourt generashon.”
Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel.