Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
King Jehoram na thirty-two years wen e bi king and e rule for eight years from Jerusalem. En deat nor pain anybody at-all and dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
King Uzzaya die and dem beri am near en grand-grand papa for where dem dey beri kings. (Dis na bikos e get skin diziz.) En pikin Jotam kon take-ova as king.